Popular Nigerian comedian, Ayo Makun, wey everybody sabi as Comedian AY, don open mouth talk about how some celebrities for Nigeria dey live fake life.
AY yarn say many of dem no dey live the kind life wey dem dey show for social media. According to am, some of dem dey borrow wig, shoe, and cloth just to take snap picture or do video make e look like say life don better.
For one interview wey go viral online, AY talk say:
“Some people dey live for Instagram oh, dem dey borrow wig, shoe, car, even house just to do show-off. Life no be competition, but some people dey try form what dem no be.”
E still add say many young people don dey under pressure because of wetin dem dey see online, as dem wan copy lifestyle wey no real.
AY come advise upcoming entertainers make dem no kill demself to impress people wey no send dem.
“Na content dem dey post, no be reality. No go borrow shoe because another person post designer boot,” e talk.